International

Brazil Former Presido Bolsonaro Don Collect 27 Years Prison For Coup Wahala

todaySeptember 12, 2025 6

Background
share close

Former Brazil Presido Jair Bolsonaro don collect 27 years and 3 months for prison after dem find am guilty say e plan military coup to hold power tight after im lose 2022 election. Panel of five Supreme Court judges yan judgment on Wednesday, four say na guilty, one no gree. Di ruling don also block Bolsonaro from ever hold public office until 2033. For now, dem keep am for house arrest because dem fear say e fit run. E no show face for di sentencing. Bolsonaro lawyers vex, say di punishment na “overdo” and dem talk say dem go appeal sharp-sharp. Di former oga don always talk say di case na “witch hunt” wey dem plan just to stop am from contesting 2026 presidential election, even though another case don already block am from holding office.

Di ruling scatter plenty reactions across borders. US Presido Donald Trump wey don support Bolsonaro before, say di judgment shock am, e even compare am to di wahala wey e dey face for court. US Secretary of State Marco Rubio blast di judgment too, say e no fair at all and warn say kasala fit burst. Brazil foreign ministry no take am light, dem fire back say Rubio dey make “threat” but Brazil democracy no dey shake. Dem talk say di judgment get strong evidence to back am.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app