National

Obidient Movement Beg Jonathan Say Make He Step Down For Peter Obi!”

todaySeptember 12, 2025 6

Background
share close

Obidient Movement don beg former Presido Goodluck Jonathan make e support Peter Obi instead of drag position with am for 2027 presidential election. Di beg come shortly after Peter Obi and Jonathan hold one coded closed-door meeting on Thursday. Obi even post pictures of both of dem for him X handle, call Jonathan “my elder brother wey I hold well, better statesman and true leader.” Obi talk say wetin dem discuss na how Nigeria matter be right now. Even though people dey yan say Jonathan fit run for president again come 2027, di former presido never open mouth talk anything officially.But di Obidient Movement don tell am make e no enter race, say make e give Peter Obi chance run, for the sake of fairness and to move Nigeria forward.

National Coordinator of the Obidient Movement, Dr. Yunusa Tanko, talk say even though both Peter Obi and Jonathan na respected leaders, Obi still be the main man wey millions of Nigerians dey look up to for better direction. “Dem two don be padi for long. Di meeting na just to bond and talk how dem fit join hand save Nigeria,” na wetin Tanko talk. “But for we wey dey Obidient Movement, e go make sense well if Jonathan just hold him respected elder statesman level. He don do him part as Presido, everybody respect am, and this time na to support him brother,” he talk.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app