Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Nigeria National League, NNL, don tell all di clubs make dem upgrade important things for dia home stadiums before di 2025/26 season go start. Dis order na part of di tori wey dem drop for di communique after dem do dia 15th Annual General Meeting wey shele on Tuesday, 16th September, 2025, for Kaduna State. Di communique talk say: “Di NNL Annual General Meeting agree say na only stadium wey meet di correct NNL stadium facilities level go get approval to host match for di 2025/2026 League season.” Make you remember say dem don fix Saturday, 8th November 2025, as di kickoff date for di 2025/26 NNL season with one big opening match between Lobi Stars of Makurdi and City FC of Abuja. But all di other match day 1 games go happen on 14th and 15th November 2025 for different stadiums wey dey spread across di country.
Still for di mata, “di AGM don cancel di Super 8 play-off wey dem dey use take decide which four clubs go promote enter Nigeria Premier Football League (NPFL).” From now on, any club wey finish top for each of di four conferences go sharply move up enter NPFL straight. No more Super 8 palava. Di AGM still yan say dem go run Super 4 Tournament after di season finish to take know who be di real champion of di League. Dem come add say any of di four clubs wey no gree show face for di Super 4 Tournament go automatically lose dia promotion slot, and na di second club for that conference table go sharply collect am.
Written by: News Editor 1
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025