Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Di Flying Eagles don ready to start dia first training session on Wednesday morning, after dem land for Chile on Tuesday for di 2025 FIFA U20 World Cup. Di seven-time African champions land after one long flight from Nigeria, wey dem take off on Sunday night. Dem use Tuesday to rest from travel tiredness and jet lag, and now di team go start double training sessions by 7:30 a.m. and 5:00 p.m. (local time) on Wednesday. Under head coach Aliyu Zubairu, di team dey prepare for tough Group F wahala, wey dem go meet Norway, Saudi Arabia, and Colombia. Nigeria go start dia tournament against Norway on Monday, 29th September by 9:00 p.m. local time, then dem go play Saudi Arabia on 3rd October and Colombia on 6th October.
Zubairu, wey lead Nigeria finish third for 2025 CAF U20 Africa Cup of Nations wey hold for Egypt, dey aim to carry di team go pass dia best before for FIFA U20 World Cup wey na runners-up dem be in 1989 and 2005. As part of their last preparations, Nigeria Football Federation don arrange two international friendly matches against host nation Chile and Australia to help sharpen di squad before dem start dia first match.
Written by: News Editor 1
FIFA U20 WORLD CUP 2025 FLYING EAGLES SQUAD 2025
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025