Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Five-time world champions, Golden Eaglets, go face Black Starlets of Ghana for di second semi-final of di ongoing WAFU-B U-17 Championship wey go shele today Tuesday for Stade Charles Konan Banny, Yamoussoukro, Ivory Coast. One year after dem no fit reach final for di last edition wey make dem miss out for 2025 U-17 AFCON and even di expanded FIFA U-17 World Cup di team don enter another serious wahala to qualify for di main tournament. Golden Eaglets don dey show correct form for di tournament, as dem don score four goals and just collect one, gather four points to top Group B wey get three teams. Under di control of coach Manu Garba, di boys wipe Baby Cheetahs of Benin Republic 4-1 for dia first match last Wednesday, before dem play 0-0 draw with Burkina Faso for dia second game.
As for Ghana Black Starlets, dem struggle reach dis level. Dem play 1-1 draw with Togo for dia first Group A match, then chop 3 goals from dia host country, Ivory Coast, for dia second game dem almost comot from di tournament when di match against Niger Republic still be 1-1, but na two late goals for second half save dem as dem manage win and qualify enter semi-final. So, dis semi-final clash between these two West African giants go hot well well and promise to be interesting. But Golden Eaglets don get upper hand pass Ghana for WAFU-B U-17 Championship history. For di 2022 edition wey Ghana host for Cape Coast, Golden Eaglets beat Black Starlets 4-2 for di opening game. Na di same shout of victory wey full Golden Eaglets camp when dem beat Black Starlets 3-2 for di bronze medal match of di last edition wey happen for Accra, Ghana. If Golden Eaglets fit win today’s match again, e no go just carry dem enter final e go also qualify dem for di 2026 Africa U-17 Cup of Nations. After dem no fit reach final for last year edition, Eaglets miss di 2025 U-17 AFCON and as e be like that, dem no see chance play for di expanded FIFA U-17 World Cup competition wey dem don win five times. Today’s clash go kick off by 8pm.
Written by: News Editor 1
GOLDEN EAGLETS VS GHANA U-17 AFCON QUALIFIERS 2025
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025