Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
President Bola Ahmed Tinubu, yesterday, canvass new orientation by Nigerians, urge dem make dem always lift di country, believe in her and put her first at all times in all wetin dem do. He come beg Nigerian people make dem embrace optimism and join hands to shape di country future, urge dem make dem throw away bad belle mindset and remember di values of confidence, resilience, and unity wey define di generation wey start dis nation. As President Tinubu dey speak for di inauguration of di newly renovated Wole Soyinka Centre for Culture and Creative Arts, wey before na National Arts Theatre, as part of Nigeria 65th Independence anniversary celebration for Lagos, he warn make people no dey always talk bad about Nigeria, say di country future dey di hand of Nigerians themselves. Make una stop to dey talk Nigeria down with negative mouth. No be only education matter, even educated derelicts full everywhere for di world. Wetin really matter na make we believe in ourselves. We be nation of brave, confident, and committed people. Make we build am together. Make we even give am new name.
President Tinubu, wey call di evening wonderful and inspiring, come announce say he go personally drop money for di endowment fund to help sustain di Centre. He direct di Central Bank of Nigeria (CBN), make dem work with di Bankers’ Committee to design di plan. He talk say the fund no just suppose maintain di place for long, but e gats create jobs and support people wey dey hustle inside di culture and creative space. Na now Cardoso and di rest go gather dis endowment fund, and I go drop my own contribution, Tinubu talk. Di worst don pass. We go turn di corner. Di economy don recover, and I sure say prosperity dey come. For im own side, di Governor of di Central Bank of Nigeria (CBN), Mr. Olayemi Cardoso, reveal say di Bankers’ Committee put down about ₦68 billion to take transform di Wole Soyinka Centre for Culture and Creative Arts, and make sure say di renovation work become big success. Cardoso explain say the project no be just corporate social responsibility, but one serious strategic investment inside Nigeria creative economy, one wey go bring long-term benefit like tourism boost, youth employment, and make Nigeria stand gidigba for global competition. He praise di unity of purpose wey help deliver di project, even with all di wahala wey show face, like structural problems, contract delays, and di global pandemic wey scatter plenty plans. Di president still talk say Nigeria don turn di corner” and say di worst don pass, as he beg Nigerians make dem stay di course because di reforms wey im government dey do don dey hold ground well well.
Written by: News Editor 2
NATIONAL ORIENTATION NEW NIGERIA PATIOTISM
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025