Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
“Federal Government don settle wahala between Dangote Refinery and Petroleum and Natural Gas Senior Staff Association of Nigeria (PENGASSAN), wey bin dey shake fuel supply for ground.” “Afta two days gist on Monday and Tuesday, dem don reach agreement say di workers wey dem sack go get chance work for other Dangote companies, and dem no go lose shishi from dia salary.” “Na Minister of Labour and Employment, Dr. Mohammed Maigari Dingyadi, call di peace meeting come as PENGASSAN give order make dem cut gas supply and comot dia workers from di refinery, after over 800 staff chop sack.” “Big ogbonge meeting wey happen, National Security Adviser show face, plus Ministers of Finance, Budget and Economic Planning, Labour and Employment, and State for Petroleum (Gas), join body. Directors-General of DSS and NIA sef no miss am.” “For him talk, Dr. Dingyadi remind both sides say ‘workers get right to join union as Nigerian law talk, and everybody gats respect am.’”
“The communique wey dem sign yarn three major decisions:”
“Reabsorption of Workers: ‘Dangote Group management go sharply begin to carry back di workers wey dem sack go other companies for Dangote Group, and dem no go lose any salary,’ na wetin di statement talk.”
“No Victimisation: Both sides gree say ‘no worker go suffer or get wahala because of how dem take do for di matter.’”
“Strike Suspension: PENGASSAN also confirm say dem go ‘begin di process to stop di strike.’”
“Di communique end talk say all sides enter di agreement ‘with clean heart.’ Di wahala don cause gbege about fuel supply and power fit stop. Federal Government don assure Nigerians say ‘fuel go dey steady and no go run comot’ even as di fight dey, because dis matter na serious one for di country.” “With dis agreement, peace don land small for work matter, but some experts still talk say big yawa still dey for how oil and gas workers and company dey relate.”
Written by: News Editor 1
DANGOTE GROUP NIGERIA LABOUR STRIKE RESOLUTION PENGASSAN Strike
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025