Listeners:
Top listeners:
KonfamFM 89.5 We Dey For You
“President Bola Tinubu don talk am again say make Nigerians dey buy made-in-Nigeria products.” “According to am, we suppose be nation wey produce things, no be only to dey consume.” Tinubu yan dis one for im speech wey im give as Nigeria dey celebrate 65 years independence for Abuja on Wednesday. ‘For dis 65th anniversary of our independence, my message na hope and make una ready to take action.’ “Dis Federal Government go still dey do im own to fix how our economy dey run. Now, we all gats open the taps of productivity, innovation, and enterprise.”Tinubu talk say di government don break record for how much money dem dey collect from non-oil things, finish 2025 target as early as August with over N20 trillion. E talk say for September alone, non-oil revenue reach N3.65 trillion, plus say e pass May 2023 amount by 411 percent.
Di president talk say Nigeria don get trade surplus for five quarters straight. “Now, we dey sell pass wetin we dey buy for di world, na big change wey go make our currency strong and create work for people for here.” “Nigeria trade surplus grow by 44.3 percent for second quarter of 2025 reach N7.46 trillion (4.74 billion dollars), na di biggest in almost three years,” e talk. Tinubu yan say goods wey dem make for Nigeria and export don jump by 173 percent. For her own talk to mark Nigeria independence, Minister of Industry, Trade, and Investment, Jumoke Oduwole, yan say Made in Nigeria products na way to grow economy, create jobs, and develop di country. According to her, e important say make we buy wetin we produce and produce wetin we dey consume. So, I dey urge Nigerians make dem support Made in Nigeria products. Also, Nonye Ayeni, di Director-General of Nigerian Exports Promotion Council (NEPC), talk again say di council dey committed to build exporters’ power from di farm gate go all di way to market
Written by: News Editor 1
Asiwaju Bola Ahmed Tinubu LOCAL INDUSTRY SUPPORT LOCAL PRODUCT SUPPORT
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025