Super Eagles head coach Éric Chelle don talk say Victor Osimhen na di best striker for di world after di Galatasaray star carry di team waka win Benin Republic for Uyo on Tuesday. Nigeria knack 4-0 for di 2026 FIFA World Cup qualifying matchday 10. Osimhen score two goals for di first half and still add another one after di break. Chelle come talk say im players be champions, say dem deserve di win even though e no easy with new coach and new style, but di players adapt quick quick.
Now, Super Eagles go shift eye to di playoffs wey dem go face Cameroon, Gabon and Democratic Republic of Congo. Chelle talk say e dey ready for di challenge and e proud of everybody, including di fans wey push dem. E yan say “Now we go Morocco, e go hard but na di beginning. I proud of everybody.” Di Malian coach sure say better tins dey come for Nigeria football.