Sports

Eagles World Cup journey No smooth – Ekong Yarn

todayOctober 16, 2025 6

Background
share close

Super Eagles skipper, William Troost-Ekong don open up say Nigeria journey to di 2026 FIFA World Cup still long and no easy at all, even though dem don qualify enter di CAF Play-off Tournament wey go happen for Morocco next month. Na after dem knack Benin Republic 4–0 for Uyo on Tuesday give dia best performance so far for di qualifiers. But even with dat kind big win, e no still reach to carry automatic World Cup ticket. Now, di three-time African champions go need pass through di play-offs if dem wan still get hope of reaching di World Cup. After di match, Ekong hail di team for dia resilience and unity, but still yarn say di road no smooth. “We happy say we still get chance.

E long, but at least na still chance. We for like carry automatic ticket, but e no work. So we go face wetin dey our front and give all till we reach dat World Cup,” na wetin Ekong talk. Di Super Eagles defender still praise di full team effort for di win against Benin, as everybody play dia role well. “Na team effort wey make Tuesday game sweet. Everybody contribute. If dat other match go our way, we for don hold dat ticket. But na so life be , you collect wetin you see, make am work for you,” he add. Victor Osimhen na di real star of di night as e score hat-trick, before Frank Onyeka seal di win for stoppage time. But Rwanda no fit stop South Africa for Mbombela, so Eagles no fit top Group C. For di CAF play-offs wey dey come, Nigeria go jam Gabon for di first semi-final on Thursday, November 13, while Cameroon go face DR Congo di next day. Di winners go play final on Sunday, November 16, and di champion go enter intercontinental play-offs for March 2026. Dat final play-off go happen for Mexico, and na six teams go dey fight for two remaining World Cup slots: Africa rep, Bolivia, New Caledonia, Asia play-off winner (Iraq or UAE), and two from Jamaica, Costa Rica and Panama.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app