Sports

Postecoglou Comot As Forest Coach After Chelsea Defeat

todayOctober 20, 2025 5

Background
share close

Nottingham Forest manager Ange Postecoglou don lose him job on Saturday after just eight matches as coach, minutes after Chelsea waka come City Ground carry 3-0 win. Di club put for X say, “After plenty bad results and poor performance, Ange Postecoglou don stop to be head coach immediately.” Di club no want talk more for now. Forest owner Evangelos Marinakis leave him seat during di match, and after full-time, dem confirm say Postecoglou no go dey again.

Postecoglou start work for September 9, after im Europa League win with Tottenham, but after no win and six loss from di first eight matches, Marinakis decide to sack am. Dis make Postecoglou di third Forest coach wey dem sack dis season. For Friday pre-match press conference, Postecoglou talk say if dem give am time, e go always end wit trophy. Now, former Burnley and Everton coach Sean Dyche dey for di list to take over as new boss.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app