National

Student Dey Threaten University With N500m Lawsuit Over Fake Admission Gbege

todayOctober 23, 2025 5

Background
share close

One 200-level Law student for Achievers University, Owo, Ondo State, Akinlolu Richard Omisade, don threaten to drag di school go court to collect N500 million over fake admission wey JAMB no recognize. Di student lawyer, Barrister Abdulfatai Abdulsalam, deliver protest letter to Vice-Chancellor office, talk say di university no send Omisade details to JAMB for proper registration, and di admission letter wey dem give am na fake.

According to di letter, Omisade get admission letter dated August 16, 2024, but when dem check JAMB portal, im name no dey among admitted students. Di lawyer give di school three days to sort di matter with JAMB or face law wahala to pay N500 million for damages. Di school PR, Olaniyi Adekanye, talk say dem dey reason with di student parents to settle di matter peacefully.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app