International

183 Million Gmail Passwords Don Leak As Data Breach Burst Out

todayOctober 28, 2025 2

Background
share close

Gmail users don dey get serious warning make dem check dia accounts after dem steal over 183 million passwords for one massive data breach. Australian cyber expert, Troy Hunt, wey first reveal di matter, describe am as one “vast corpus” of leaked data wey reach 3.5 terabytes e talk say na di same size like 875 full HD movies put together. According to Hunt, all di major email providers dey affected no be only Gmail, but Outlook, Yahoo and di rest. “Dem come from everywhere wey you fit imagine, but Gmail always plenty pass,” Hunt yarn give Daily Mail. Di wahala happen since April but dem just reveal am now for Mr Hunt’s website Have I Been Pwned (HIBP).

Hunt explain say di leaked data get 183 million unique email addresses, together with di websites where dem use am and di passwords wey follow. But e still talk say no be one single hack o, na collection of “stealer logs” data files wey malware (bad software) dey generate and compile from different corners. According to am, “Stealer logs na like tap wey no dey off, e just dey pour people private info anyhow.” E still warn say once di bad guys don get your data, e go begin spread like fire for different channels and platforms. Mr Hunt con advise make people quickly go Have I Been Pwned website, type dia email for di search bar, press “Check,” and see whether dia data don leak or dem dey safe.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app