Sports

My Priority Na To Help Atalanta – Ademola Lookman

todayOctober 29, 2025 4

Background
share close

Nigerian international Ademola Lookman don talk say im main focus na to help Atalanta reach dia goals dis season. Di Super Eagles winger find back im scoring form on Tuesday evening as e score im first goal of di Serie A campaign for Atalanta 1-1 draw against AC Milan, a performance wey make dem give am Man of di Match award. After di match, Lookman yarn say e still dey work on getting back to full form but im mind still dey set to contribute to di team success. “E important to dey available for di team, to help di team,” Lookman tell DAZN Italia. “I never really find my full form yet, physically or for goal front, but I go reach dia soon. Dis one na step for di right direction, and hopefully, for di next games, we go begin collect wins,” he talk.

Di 26-year-old still stress say di team own success na im top priority. “Anytime wey I dey for pitch, di most important thing na to help di team win. We wan dey climb up for table, and na di priority be dat, to dey win football matches,” e add.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app