Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Government don yan say dem go digitalize and automate di way dem dey give approval for telecommunication infrastructure project through one new platform wey dem call Telecommunication Infrastructure Regulatory System (TIRS) wey go launch by February 2026. Di General Manager of Lagos State Infrastructure Maintenance Regulatory Agency (LASIMRA), Prince Oyekanmi Elegushi, talk dis one for statement wey him sign. According to am, di new system go make sure say all telecom project for Lagos follow regulation well, and e go make di whole process transparent, sharp, and accountable. Di TIRS platform go help fast-track how companies take get permit to install mast, tower, and right-of-way for fiber optic cable, without all di long waka and unnecessary physical wahala.
Elegushi talk say di new TIRS go cut human interaction by almost 99%, as companies go fit now apply for mast, tower, and fiber permit online without waka go any office. E still reveal say LASIMRA don already train all dia staff both theory and practical to sabi how di system go take work well once e start to operate. E add say dis move show di Lagos State Government commitment to build better, open and investor-friendly environment for telecom operators. Di GM also yan say di TIRS dey in line with Governor Babajide Sanwo-Olu vision to push digital governance and use technology take improve service delivery for di state.
Written by: News Editor 2
Lagos digital platform telecom infrastructure approval
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025