Lagos

One Die, Four Wound for Lagos-Ogun Road Crash

todayNovember 4, 2025 2

Background
share close

One person don kpai while four others don wound for two different motor accidents wey happen Sunday night for Oniru area of Lagos and Saapade side of Lagos–Ibadan Expressway. Di first crash for Oniru happen around 11:46 p.m. when one Nissan Saloon car with plate number LND 738 FQ lose brake and somersault. Di Permanent Secretary of Lagos State Emergency Management Agency, Olufemi Oke-Osanyintolu, talk say di car wey di driver dey alone inside develop brake failure and crash into streetlight, wey cause di man death instantly. Dem hand over di body and di damaged motor to police for further action.

Di second crash happen for Saapade area of Ogun State around 5 p.m. when one Toyota bus with plate number BGT 600 XA and one Mercedes-Benz bus with plate number XF 416 BDJ jam each other. Ogun State Traffic Compliance and Enforcement Agency talk say di Benz driver dey try overtake truck when he face di Toyota bus wey dey drive one-way, and di two motors collide. Four people two from each bus sustain injury and dem rush dem go hospital, while police for Isara-Remo carry di accidented vehicles. Recently, Lagos and Ogun roads don dey record plenty crashes wey claim lives, as reckless driving and bad vehicle condition still be di main wahala for di highways.

Written by: News Editor 2

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app