Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Lagos State Government don run go Supreme Court to beg make dem uphold di conviction of Dr. Olufemi Olaleye, di Medical Director of Optimal Cancer Care Foundation, wey dem first sentence to life imprisonment for defiling im wife 16-year-old niece. Di Lagos State Sexual Offences and Domestic Violence Court bin convict am for October 2023, but Court of Appeal for Lagos later free am for November 29, 2024, say di evidence wey prosecution present get plenty wahala and no balance well. As e no sweet Lagos Government, dem carry di matter go Supreme Court to challenge di Court of Appeal decision wey clear Dr. Olaleye for di defilement case.
But Dr. Olaleye lawyer, Chief J. Okutepa (SAN), don file objection make Supreme Court throway di appeal say e no get correct ground. Lagos State Government respond say di objection no get base and na technical talk wey no hold water. Dem beg di apex court make e reject di lawyer submission and bring back di original judgment of di trial court. For dia appeal, di state government build dia argument on four major points wey show why Supreme Court suppose confirm di life jail sentence. One of di grounds na to make di court decide whether dem fit raise di issue of di victim age after trial, and whether di prosecution no already prove say Dr. Olaleye really commit di offence of child defilement and sexual assault by penetration as Lagos law talk.
Written by: News Editor 2
Lagos Supreme Court new Sexual assault conviction Nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025