Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Activist and former presidential candidate, Omoyele Sowore, don reject di Lagos State Police Command decision wey tag am as “wanted person” over alleged plan to cause public wahala for di state. Di Lagos Commissioner of Police, Olohundare Jimoh, talk say Sowore and im Take It Back Movement members wan block major roads like Third Mainland Bridge, Lekki Tollgate, and Freedom Park to protest di recent Oworonshoki demolition. Jimoh claim say dem warn Sowore before make e no mobilize protest, but e ignore dem. Di CP talk say 13 suspects don already land for police hand as dem deploy officers go highways and bridges to stop any unrest. E even yarn say Third Mainland Bridge no fit carry crowd weight, and anybody wey wan cause gbege go face di full weight of law.
But Sowore don fire back say di police just dey find excuse to silence am and twist di real story. For im post on X, e talk say di CP dey lie, and say e don try call am several times but e no gree pick. Sowore insist say di police wan frame am because dem no fit carry out “shoot-on-sight order” from di IGP. E still plan to meet di CP face-to-face to clear di matter. Di activist don vow before say e go protest di Oworonshoki house demolition wey e call wicked and inhumane, but police dey warn say even though freedom of expression dey, e no suppose turn to public chaos.
Written by: News Editor 1
Breaking news Lagos Sowore Lagos protest Sowore vs police
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025