Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Crisis don burst inside Super Eagles camp for Rabat, Morocco, as players refuse train on Tuesday ahead of dia 2026 FIFA World Cup African playoff clash with Gabon. Di boys vex say Nigeria Football Federation (NFF) never pay dia allowance and bonus wey dem owe. Team captain, William Troost-Ekong, confirm di boycott for im X handle (wey dem dey call Twitter before), as e talk say di protest no be about any special bonus for di playoff match. “Once we settle di matter, we go talk am first. Any other gist wey you hear no true. All we want na to focus on di big games ahead,” Ekong yarn.
Report show say di players still dey wait for dia allowance for qualifying for di 2025 AFCON plus other entitlement wey join di 2026 World Cup playoff. Some early reports talk say di wahala na because of new allowance wey dem propose for di Morocco match, but Ekong clear am say na old payment matter dey cause di gbege. Di NFF never drop official statement as di kasala fit scatter Nigeria plan for Thursday big clash with Gabon, wey go affect dia World Cup qualification hope.
Written by: News Editor 1
Super Eagles news Super Eagles protest Super Eagles unpaid allowances
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025