International

Trump Honour Ronaldo – “My Pikin Love You Well-Well”

todayNovember 19, 2025 5

Background
share close

President Donald Trump don talk say im pikin, Barron Trump, na big fan of Cristiano Ronaldo. Dis kind talk come after Ronaldo meet Barron before Trump honor am for White House dinner on Tuesday night. Ronaldo dey part of di delegation wen US leader host Saudi Arabia Crown Prince, Mohammed bin Salman, for Washington DC. Ronaldo, wey be captain of Saudi Pro League team Al Nassr, and im fiancee, Georgina Rodriguez, waka go USA for di event. Di 40-year-old show for di dinner for black tuxedo sidon near people like world richest man Elon Musk and US Vice President JD Vance.

Trump mention di Portuguese football legend during im speech for di dinner. According to Trump, di former Manchester United, Real Madrid and Juventus superstar don meet im pikin, wey dey big fan of soccer. “My son na big fan of Ronald, Barron meet am and I think im dey respect im papa small more now, na because I introduce una. So I wan thank both of una for dey here,” Trump talk. Meanwhile, Ronaldo show red card for Portugal FIFA World Cup qualifying match against Ireland and im dey suspended for di win against Armenia on Sunday, wey confirm Portugal secure place for 2026 World Cup wey go hold for USA, Mexico and Canada.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app