Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Morocco and PSG star defender Achraf Hakimi don win di 2025 African Men’s Player of di Year after he finish ahead of former winners Victor Osimhen and Mohamed Salah. Hakimi be di first Moroccan since Mustapha Hadji for 1998 to carry di prestigious award and di first defender since Bwanga Tshimen for 1973 to be crowned Africa best. Di right-back play key role for PSG and Morocco, e help di French giants land treble: Ligue 1, French Cup and dia first UEFA Champions League title, even score opener for di 5-0 final win against Inter Milan. E still lead PSG reach di FIFA Club World Cup final wey dem lose 3-0 to Chelsea, and also help Morocco qualify for next year FIFA World Cup, although fear dey say injury fit make am miss AFCON for im country.
For di women category, Morocco’s Ghizlane Chebbak beat Super Falcons and PSG forward Rasheedat Ajibade to grab di crown. Yassine Bounou collect CAF Men’s Goalkeeper of di Year, while Nigeria’s Chiamaka Nnadozie retain di Women’s Goalkeeper award for di third straight year after helping Super Falcons win WAFCON. Cape Verde coach Bubista win Men’s Coach of di Year for leading dem to dia first-ever FIFA World Cup, while some awards like Women’s Coach of di Year and Women’s Interclub Player go come after di ongoing CAF Women’s Champions League. DR Congo striker Fiston Mayele pick Men’s Interclub Player of di Year, Othmane Maamma take Men’s Young Player, and Doha El Madani keep Women’s Young Player award. Morocco Under-20 team win Men’s Team of di Year, Super Falcons be Women’s Team of di Year, Pyramids carry Men’s Club award, and Tanzania’s Clement Mzize win Goal of di Year for im long-range banger against TP Mazembe.
Written by: News Editor 1
African Footballer of the Year CAF Awards 2025 Hakimi African Player of the Year Morocco football star Hakimi
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025