Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
Pandemonium bust out on Tuesday as gunmen wey dem believe say na rival cult groups begin fire gunshots during di annual masqueraders festival for Orile Iganmu area of Lagos State. At least three people die for di gbege, and many others injure. Di festival, wey dem dey celebrate every year with di tall Igunnuko masquerader, turn violent immediately after di masquerader show face for di usual Tuesday procession. Instead make dem shoot for air behind di masquerader as tradition talk, one suspected cult leader and him boys begin target dia rivals directly. Residents talk say na when di boys sight each other di whole thing scatter. Two bodies remain for di scene while one person dem carry comot, as panic catch participants wey dey run for safety.
Another resident yarn say di festival suppose promote peace and stop calamity, but this year own turn wahala, something wey never happen before. Anti-cultism group, Naija Confra, confirm for X say na three dem shoot and kill for di Aye side, and say one notorious Eiye member, Babalawo, don run go Ilorin after di shooting. Police PRO Abimbola Adebisi no respond to calls or message as at di time of report. Dis violent display come few days after another suspected cult clash for Agbarho, Delta State, where two men, Jonathan and Konto, dem stab to death.
Written by: News Editor 2
Lagos breaking news Lagos cult clash
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025