Govos and Traditional Rulers for north don form geng enter meeting for Kaduna, order say make mining stop for at least six months, and dat illegal mining, na im dey cause all di katakata of security for di North.
Di leaders dey para say dat pipo dey face serious gbege wit Jaguda boys and so don set up regional Security Trust Fund, wey every state and local gornment go drop ₦1bn monthly to rascal di Jaguda boys for North.
For di announcement wey dem drop after di Kaduna meeting on Monday, di govos yarn yarn marras dat Security Trust Fund go bring beta owo for ground to run joint patrols, intelligence waka, and handle security wahala across di North.
Dem dey feel for Kebbi, Kwara, Kogi, Niger, Sokoto, Jigawa, Kano, Borno and Yobe pipo wey dey face security palava, salute soldiers, and give oga Presido Bola Ahmad Tinubu thumbs up as demma take try release those school childrenses from those Jaguda boys. Di Forum dey beg Presido make e run enter di bad boys’ hideouts sharp-sharp, make peace land for North and make people fit finally dey free.