By Rilwan Agbomeji
Liverpool oga Arne Slot don burst confirm say Mo Salah go waka comot Anfield go link up wit Egypt for AFCON on December 15.
Slot drop di tori before Liverpool face Sunderland, yarn say na FIFA order say December 15 na di final day wey club must release players.
Egypt sef no dey dull dia AFCON camp don open and dem get friendly match wit Nigeria on December 10 to ginger body. Slot hail Salah say di guy dey run like “superhuman,” but admit say even king fit tire as Liverpool go manage without dia main hitman during AFCON.