National

Sowore Face Court Over Anti-Tinubu Post, Comot On Self-Recognition

todayDecember 3, 2025 5

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Na big gbege shele for Abuja on Tuesday as Omoyele Sowore, land Federal High Court, dey face DSS on top wetin im yarn for post on social media say President Bola Ahmed Tinubu na “criminal.”

Di mata serious as DSS drag am for five counts of criminal defamation, and even Meta (Facebook) plus X Corporation (Twitter) join di hot gbege as co-defendants.

DSS yarn say Sowore dey spread tori wey no true at all and dey drag oga Tinubu image come down for im correct accounts wey get blue mark, and di koko dey under di Cybercrimes Amendment Act, 2024.

Sowore lawyer, Marshal Abubakar, kon fire back, yarn say di charge no get sense, plus di court don already adjourn di case two times, but DSS still dey push make dem issue bench warrant, tension full ground, everybody dey wait wetin go happen next.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app