By: Rilwan Agbomeji
Fulham winger, Alex Iwobi don fire up im boys afta dem loose 5-4 giv Manchester City for dia own house for Tuesday.
Fulham Boys no come sell groundnut ooo as dem match City fire-for-fire, push dem sotay e remain small make dem thief one point comot Pep hand.
Na Iwobi even light di fire as e tear net with one mad goal afta second half pass small, na im everywhere burst for stadium like say dem win cup.
But afta di hot fight finish, Iwobi still stand gidigba yarn say na to gather body, raise chest up no bend neck, and no allow di loss scatter dia morale as oda battles still dey front.