Listeners:
Top listeners:
play_arrow
KonfamFM 89.5 We Dey For You
By: Rilwan Agbomeji
For Wednesday for Abuja, We Senate don run mata again katapot change for di 2022 Terrorism Act say, moving forward, any jaguda wey do kinaping, whether na money take support oh, or na u spiderman wey give informate, or ur work na to hide victim, any how any how so far u dey involve say na death penarity now ooo.
Di bill show bodi for di house as Senate Leader, Opeyemi Bamidele drop am bitwei, as im carry talk am, kidnapping, hostage-taking and any back-end support na pure terror work for di nation.
Lawmakers yarn say di move go giv security agencies mad power to touchlight dirty money, scatter supply lines and run sharp operations wey fit burst kidnaping for di obodo Naija kpatakpata.
For inside general meeting wey Senate Presido Godswill Akpabio dey control, senators from all corner hail di change like say dem kill lion wey dey press di country for neck.
Written by: News Editor 1
kidnapping in nigeria nigeria terrorism law senate death penalty nigeria
We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.
We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!
Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!
Copyright KONFAM 2025