By: Rilwan Agbomeji
At least one person don kpai afta heavy fight burst between suspected Aiye and Eiye cult members for Awoyaya, Ibeju-Lekki, Lagos.
Di fight burst from Monday enter Tuesday, and before people know wetin dey sup, one guy wey dem sabi as Pelebe don kpai inside di cult gbege.
Videos just dey show show bodi online how di wahala, take scatter pipo for Awoyaya .
Di video show am lying for ground, body no stable, as di whole area scatter.
As at di time wey we take package di report, police still neva talk anything on di matter.