By: Alice Iduh
Wi Oga Presido Bola Tinubu, based on doings don cut cap for Nigeria armed forces for di way dem rush help Republic of Benin stop coup wey scarra the country Sunday.
According to di President, wey him talk through him Adviser on Information and Strategy, Bayo Onanuga, di military restore democracy after di coup plotters capture National TV and one military camp.
Tinubu yan say di forces act according to ECOWAS rules and make Nigeria proud as dem protect democracy.
E add say Nigeria go continue dey support Benin government and people, as di Air Force jets enter Benin airspace to dislodge di plotters.