By: Rilwan Agbomeji
Tori dey fly fly down and up say Super Eagles keeper, Stanley Nwabali, fit miss AFCON 2025 as im still dey battle ankle and hand Wunjury.
Chippa United coachie, Vusumuzi Vilakazi, na carry marras for hea dey yanyanpu give tori pipo say, Nwabali get wunjury.
Vilakazi talk say na during Nigeria World Cup playoffs for Morocco last month e worsen di injury, and since e come back, e never keep post for Chilli Boys again.
Nwabali, wey don turn Super Eagles number one since AFCON 2023 for Ivory Coast, now dey fight clock to see if e go fit return.