By: Alice Iduh
Nor be small happiness one finish niger state govo, Umaru Bago for face, as im ma receive di 100 pikins wey jaguda boyz bin kpake from st. Mary’s catholic school for papiri afta federal gornment secure dem.
Di matter be say, how security take rescue di childrensis, nor sti dey clear oh, whether, na mind rob oh with the jaguda boys, abi na force, or whether dem pakage money give the jaguda boys, no body know.
Di pikin dem arrive government house around 5:20 p.m., where di governor hail di Nigeria security adviser oga and all di people wey help bring dem back.