By: Rilwan Agbomeji
Unto matter for sport, Nigeria Football Federation don comout clear fans doubt say dem go pay di Super Eagles coachie, Eric Chelle, salary wey dem owe am before di 2025 Africa Cup of Nations for Morocco.
NFF top official talk say, dem dey owe di franco Malian Coachie Chelle three months salary plus bonuses, and dem wan pay am make e fit prepare di team wella.
Di NFF official say Nigeria, along with 23 other teams, suppose arrange 28 players for di AFCON, with Chelle expected to announce im final squad between December 10 and 11.