By: Esther Ayoola
Nor be small gbege for di Nigerian Senate, say Naija education dey dey shakibalabala based on WAEC sudden change of curriculum and dat, SS3 students wey go register for the exam go write subjects wey dem never even see.
Na so Lawmakers fire the mata on Tuesday yarn say dem go call Education Minister plus all top heads make dem explain why dem di ss 3 chidrensis to learn wetin dem just dey see for di first time.
Senator Karimi Sunday-Steve (Kogi West) ni gongon carry di mata for head dey tuk, say the guideline suppose start after two years, but WAEC don rush am for 2026 students wey go write May/June and Nov/Dec exams.
Now everywia don spoil as students dey confuse, parents nor even understand wetin dey play, because nobody sabi how dem go arrange di new curriculum.