By: Rilwan Agbomeji
US authorities don confirm say dia forces seize one vessel for Wednesday evening afta helicopter raid near Venezuela coast.
Reports match di ship wey dem see for US footage with Skipper, using photo from TankerTrackers.com wey dey monitor oil movement.
Tracking data show say di vessel never report its location since 7 November, and maritime analysts for Kpler even believe say e do ship-to-ship transfer to cover track.
US Attorney General Pam Bondi talk say di vessel na crude oil tanker wey dem use move sanctioned oil from Venezuela and Iran.