By: Esther Ayoola
Nigeria Football Federation (NFF) don clear mata say dem nor hapi with how referees dey do their work for Naija football leagues, after Nigerian refs miss chance to officiate 2025 Africa Cup of Nations (AFCON).
NFF tuk this one after dem Executive Committee meeting wey hold for Abuja, dey call on senior mhen make dem con sponsor video assistant referee doings for the NPFL.
Confederation of African Football (CAF) no select any Nigerian match official for the tournament wey go run from December 21, 2025 to January 18, 2026 for Morocco and dis nor be di first time, because of bad workings wey dem dey show for di Nigeria professional league.