By: Rilwan Agbomeji
US military don yarn say dem don kpai four people for one latest strike on boat for Eastern Pacific Ocean.
Di gbege happen Wednesday afta US lawmakers vote down resolution wey suppose check Trump wahala for Venezuela.
US Southern Command (SOUTHCOM) talk say di four na male narco-terrorists, but dem no show any real proof say di boat dey do drug waka.
Dem still yarn say di boat dey waka for known drug route, come destroy am sharp-sharp.