Sports

FIFA Don Slam Malaysia – 3 Games Turn 3-0 Ls On Top Fake Players Wahala

todayDecember 18, 2025 3

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

FIFA don punish Malaysia with three 3-0 Ls after dem play ineligible players, Football Association of Malaysia (FAM) confirm Wednesday.

Friendly wins wey dem get against Palestine and Singapore, plus draw with Cape Verde, don turn to losses, as FIFA don strike dem.

Seven foreign-born players wey claim Malaysian ancestry don already dey suspended, and FAM don pay extra $12,500 fine on top di previous $440,000.

FAM talk say dem no do anything wrong and dem go drag marras go Court of Arbitration for Sport to challenge FIFA ruling.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app