By: Esther Ayoola
NNPC Limited omo comeout yarn marras dat say NGIC don start word afta one explosion hit part of Escravos–Lagos Pipeline System for Delta State.
Dem say afta inspection, dem don isolate di affected pipeline sections and everywhere dey safe for host communities and environment.
Joint team from NNPC, NMDPRA and maintenance contractors don visit di site make dem check wetin happen.
NNPC add say dem dey communicate with communities and authorities, and dem thank everybody for dia support as dem work to keep operations stable.