foreign

Libya Army Oga And Four Others Kpai For Plane Crash Wey Happen For Turkey

todayDecember 24, 2025 5

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Badness sup for Libya say dia oga of army , Lieutenant General Mohammed al-Haddad, and four senior officers don go kpai for plane crash for Turkey on Tuesday night.

Di plane crash happen shortly afta e take off from Ankara, Turkish capital, officials for Turkey and Libya confirm.

According to reports say Turkish security men later find di wreckage of di Falcon 50 aircraft for Haymana area near Ankara, Interior Minister Ali Yerlikaya talk.

Libya Prime Minister Abdulhamid Dbeibah don mourn di dead, call am big loss as three crew members also kpai for di plane crash.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app