By: Rilwan Agbomeji
President Bola Ahmed Tinubu on Wednesday for Lagos don set up APC committee wey go handle strategy, conflict resolution and mobilisation as party dey prepare for 2027 general elections.
Di committee get APC govos, ministers and oda big party stakeholders, with Yobe state govo, Mai Bala Buni, as Chairman, while Muiz Banire serve as member and secretary.
Oda members include Kwara state govo and NGF Chairman Abdulrahman Abdurazak, Imo state govo and PGF Chairman Hope Uzodimma, plus govos from Benue, Jigawa, Cross river, Ekiti and Delta states.
Also inside di committee na Kaduna govo Uba Sani, Rivers govo, Siminalayi Fubara, Marine and Blue Economy Minister Adegboyega Oyetola, Minister of state for defence Bello Matawalle, and Former Kogi govo Yahaya Bello.
Oga presido sha charge im mehn say make dem do di needful to install peace for di APC.