foreign

Bolsonaro Undergo Successful Hernia Surgery Afta Prison Transfer

todayDecember 26, 2025 6

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Former Brazil Presido, Jair Bolsonaro wey dey serve 27 years jail term for attempted coup don do hernia surgery and dem say e successful.

Dem carry am comot prison on Wednesday go DF star hospital for Brasília, na im first time e dey out since November.

Im wife Michelle talk say operation go well, no wahala, and dem dey wait make e wake from anaesthesia.

Doctors talk say Bolsonaro, wey don dey battle health problems since dem stab am for 2018 campaign, fit still stay hospital five to seven days.

 

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app