By: Rilwan Agbomeji
Former Brazil Presido, Jair Bolsonaro wey dey serve 27 years jail term for attempted coup don do hernia surgery and dem say e successful.
Dem carry am comot prison on Wednesday go DF star hospital for BrasÃlia, na im first time e dey out since November.
Im wife Michelle talk say operation go well, no wahala, and dem dey wait make e wake from anaesthesia.
Doctors talk say Bolsonaro, wey don dey battle health problems since dem stab am for 2018 campaign, fit still stay hospital five to seven days.