By: Rilwan Agbomeji
Di People’s Democratic Party, PDP for Lagos, don inaugurate 19 people caretaker committee wey go run di party marras for di state.
Di party talk say di Congress for zone, ward, Local and National levels go hold on January 9, 2026.
Di inauguration happen dis week under di leadership of PDP National Chairmo, Hon. Abdul-Raman Mohammed, represented by PDP deputy national secretary, Engineer Adedeji Doherty.
Doherty tell di new caretaker committee make dem remain united and follow di party constitution well well as dem dey perform dia duties.