Sports

Barau FC Comot Ladan Bosso From Work

todayDecember 31, 2025 7

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Nigeria Premier Football League (NPFL) team, Barau FC, don part ways with dia Technical Adviser, Ladan Bosso.

Di club tell tori pipo say Bosso gree step aside afta dem review di team performance for di first stanza of di 2025/26 season.

Assistant coach go take over for now as dem prepare for second stanza.

Barau FC thank Bosso for im work and wish am better luck for future, as di team finish first round 17th with 21 points from 19 matches.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app