Obodo Niger

Police Comot Hand For Tinted Glass Permit Marra

todayJanuary 2, 2026 14

Background
share close

By: Rilwan Agbomeji

Nigeria Police Force don suspend di nationwide enforcement of tinted glass permit afta court give interim order to stop am.

Police bin plan to start di enforcement January 2, 2026, say na for public safety.

According to Force PRO Benjamin Hundeyin, court serve police order on December 17, 2025, make dem no continue pending when court hear di main case.

Police don enter appearance for court, raise objection, and don ask make court cancel di interim order.

Written by: News Editor 1

Rate it

WHO WE ARE

We no be just radio, we be your guy, your gist partner, your street connect! With compassion, community, and comedy, we bring you vibes wey go make sense.

We dey kind for heart, on-time with the gist, near to the people, family by nature, always available, and plenty more!

Anywhere you dey, anytime, Konfam dey for you!

 

listen with your app