By: Rilwan Agbomeji
Former Naija Midfielder Garba Lawal don advise Super Eagles Coachie, Eric Chelle and im technical crew say make dem sort di defensive issue of di super eafles for round of 16
Nigeria go face Mozambique Mambas on Monday for Fez Stadium to fight for quarter-final spot.
Di former midfielder yarn am for on siddon talk show as fans dey ready cheer Nigeria for AFCON.
Lawal talk say e get confidence say Super Eagles go beat Mozambique if dem hold defence well.