By: Rilwan Agbomeji
Mozambique Presido, Daniel Francisco Chapo don hail di Mambas afta dem qualify for di Round of 16 for 2025 Africa Cup of Nations wey dey happen for Morocco.
E yarn tori pipo on Friday, say, di team show correct football and make di whole country proud, even though dem lose 2-1 to Cameroon for dia last group match.
Chapo say di achievement na big one wey nobody don do before, and e sweet im well well.
E still promise say if dem fit beat Nigeria for di next match, dem go collect special bonus.