By: Esther Ayoola
Information and National Orientation Minister, Mohammed Idris, tuk say dis year budget na to make sure President Bola Tinubu reform dem dey yield better result.
Idris yarn dis one for one ogbonge paper, wey dem call “A Defining Moment for Nigeria: Why Staying the Course Matters.”
E tuk say di budget na to support wetin dey work and make sure plenty Nigerians fit enjoy better life faster.
Di minister still greed at di last 31 months no easy, but e dey necessary to bring better economic change and make future stable.