By: Esther Ayoola
Federal Gornment don scarra tuk say dem abandon Nigerian students wey Morocco on scholarship, say dem nor abandon anybody, di information na false and misleading.
Dis one come from statement wey Director of yanings for Federal Ministry of Education, Boriowo Folasade, release.
According to Minister of Education, Dr Tunji Alausa, all Nigerian students wey dey on valid Federal Gornment scholarship under di Bilateral Education Scholarship Programme before 2024 don receive dia payment reach di 2024 budget year.
Gornment tuk say dem clear di mata make pipo nor dey think say dem abandon any student, say di federal gorment dey perform dia duty.