By: Esther Ayoola
Anthony Joshua don pay heartfelt tribute to im two padi, Latif Ayodele and Sina Ghami, wey kpai for car crash on December 29 for Naija.
AJ get small wunjury inside di accident, hospital discharge am, return back England, then later come back attend dia burial for last Sunday.
E call dem “brothers” and “great men”, tuk say na only afta di crash, e sabi how special dem be, and e dey grateful for all di love wey people show.