By: Rilwan Agbomeji
CAF don comot Somali referee Omar Abdulkadir Artan from handling Super Eagles vs Algeria quarter-final for AFCON 2025, wey go happen Saturday for Grand Stade de Marrakech.
Na because dem catch am say e wear boot brand wey no dey approved by official sponsors for one earlier match, and that one break CAF rule.
Even though na di same man wey win Referee of di Year for 2025 CAF Awards for Rabat, CAF say rule pass name.
Now CAF dey prepare announce new referee for di big Nigeria vs Algeria clash as fans dey wait.